Manchester City don confirm di signing of AC Milan midfielder Tijjani Reijnders for an initial fee of £46.5m on a five-year contract. Di Netherlands international be Pep Guardiola's fourth summer signing, joining Rayan Ait-Nouri, Marcus Bettinelli, den Rayan Cherki wey dem also sign.
Reijnders, wey ein age be 26, dem sign am on time so he go fit play for dis month ein Club World Cup for America. He fit make ein debut on 18 June against Wydad FC. Reijnders talk say, "I dey very happy to sign for Manchester City. City be one of di biggest teams for di world, plus di best coach, world-class players, den outstanding facilities."
He continue say, "Under Pep Guardiola, City don win so many titles, den I wan help make sure say e continue plus plenty more success for di coming years." Di midfielder don play 23 times for Netherlands but he no play for di Tuesday night game wey dem beat Malta 8-0.
He score 15 goals for 54 matches for all competitions for Milan last season, den dem name am Serie A ein midfielder of di season. As Kevin de Bruyne don leave di club, Reijnders go make di center of di pitch stronger for Guardiola as dem wan improve on top of dem ein third-place finish for Premier League last season.
Man City dey boost squad for Club World Cup
People dey ask if teams go take di Club World Cup seriously. Manchester City don show say dem dey take am seriously by signing players quick to make dem ein squad stronger.
Because De Bruyne don leave, City bin dey look at Bayer Leverkusen ein Florian Wirtz but dem decide say dem no go pursue di deal. Instead, dem don boost di side plus di signings of midfielder Reijnders, Cherki, den left-back Ait-Nouri for around £108m.
Reijnders: Di Perfect Midfielder?
- Strong on di ball
- Good passing range
- High work rate
Sky Sports ein Premier League coverage go increase from 128 matches to at least 215 games.